- Get link
- X
- Other Apps
- Get link
- X
- Other Apps
Davido Don Carry Cybertruck Enter Naija Levels – OBO No Dey Carry Last!
If you still dey doubt say OBO na the baddest, you go need to reset your mindset. Na so Davido shock everybody yesterday as im unveil him latest ride — the futuristic Tesla Cybertruck. My people, no be your regular Range Rover o, this one na tech plus luxury plus mad drip all in one!
Davido don always dey known for him lavish lifestyle and love for cars, but this one loud pass. The Cybertruck na Elon Musk latest machine wey still dey scarce even for America. Some people never even see am for road, but our own 001 don already land am.
How E Take Supp?!!
From wetin we gather, Davido don order the ride tey-tey from Tesla HQ, and dem just deliver am recently. Na the stainless steel body first catch eye — e be like something wey dem use build spaceship. Sharp edges, bulletproof skin, and no be regular steering setup at all. This one na real-life Transformer vibes.
The ride enter social media yesterday as OBO post video for Instagram story, with him usualWho dey zuzuuuu ???” caption. You know as e dey go — the video don spread like wildfire. Fans dey shout, haters dey swallow their words.
Wetin Make This Ride Special?
Video source: https://vm.tiktok.com/ZMSrkFXcD/
Cybertruck no be like your regular SUV. E get:
Electric power – Zero fuel, zero emissions. E go from 0-60 mph in less than 3 seconds. Shey you dey play me ??
Bulletproof exterior – Yes o, dem don test am with hammer and the thing no even show scratch.
Futuristic interior – Big screen, smart controls, and auto-drive features wey go blow your mind.
Massive torque– Meaning e fit drag trailer or carry heavy load like sey na keke.
No be small money Davido arrange for this car. From wetin we analyse , e go cost around $100,000, and that one never include shipping and customs wahala. But of course, 30BG no dey shout price.
Reactions Plenty for ground!!!
As expected, social media blew up:
One fan talk say Omo, this one loud! Make e just enter Lekki traffic make we see how e go behave.
Another one yarn say OBO dey live 2050 life for 2025. Who go check am🤣🤣😂
Even some celebs like Zanku and Cubana don comment with fire emojis and all. The love is massive, and the envy plenty but one thing sure: Davido just raise the bar again.
Davido no just buy car — e make statement. E show say if you dey work hard, nothing too much for you to achieve. Cybertruck no just be ride, na symbol of status, success and who-deyyyyy!
📌 Also read: Olamide Baddo Gifts ₦5,000 to TikTok Stars
So if you dey plan to buy new ride this year, better hold your chest. OBO don shift the goalpost again. Welcome to the future — Naija style!
Comments
oboooo
ReplyDelete